WORLD
2 minit wey yu go read
Bandits kidnap 55 pipo for Nigeria as peace deal dey happun
Some experts say goment suppose make peace with di bandits while odas say e no go end di problem.
Bandits kidnap 55 pipo for Nigeria as peace deal dey happun
Bandits for Nigeria dey kidnap pipo for ransom. / Others
17 Septemba 2025

Dem say na 43 pipo dem kidnap for one mosque wey dey Gidan Turbe village, for Tsafe Local Government Area for Zamfara State, wey dey northern Nigeria.

Plus, report talk say gunmen carry 12 pipo for Godai village, for Bukkuyum Local Government Area, still for Zamfara State, on Sunday.

All dis wahala dey happen as community leaders and some gunmen for Katsina State, wey dey near Zamfara, dey try do peace agreement with di bandits.

Some people wey sabi di matter dey talk say if dem wan solve di security problem for northwest Nigeria, government suppose try settle with di bandits. But some other pipo no believe say peace talk go fit end di problem.

Di attack for di mosque for Zamfara State happen around 5:30 in di morning, when pipo dey pray Fajr (early morning prayer). Report talk say di gunmen surround di mosque and carry 43 worshippers go, head towards Gahori Forest.

Nigerian Air Force don bomb some terrorist camps for Zamfara State.

Gahori Forest, wey dey Tsafe Local Government Area, na thick bush wey stretch enter some parts of Kebbi State and reach Birnin Gwari for Kaduna State. Di forest na hideout for di bandits wey dey disturb Zamfara, Sokoto, and Kebbi States.

Pipo for di area talk say some popular bandit leaders like Bello Turji, Ado Aliero, Dogo Gide, Dan Isuhu, and Black dey operate around Gahori Forest.

Residents tell Daily Trust Newspaper say di attack for di mosque don make pipo fear well well and dem no even know wetin to do again.

Dem talk say di gunmen park dia motorcycles for far place, come waka quietly surround di mosque before dem attack di worshippers.

Dis attack don make di pipo for di area dey fear more, as dem talk say di villages wey dey near di place dey suffer more attacks recently.

“People for some villages near Gahori Forest don run comot from dia houses because dem dey fear attack. Even di villages wey do peace agreement with di bandits no dey safe,” one man wey dem call Auwal Isa, wey dey live for Tsafe, talk.

“Di bandits go do agreement with one village, collect money from dem, but later dem go still attack di same village. Na di kind problem we dey face for Zamfara State,” di man add.