Wife of Nigeria President, Senator Oluremi Tinubu, show serious happy on top female chef wey be Hilda Baci, afta she set anoda Guinness World Record for cooking largest jollof rice for di world.
For di message wey her office release, Madam Tinubu talk say: "I dey congratulate you well-well for this your new Guinness World Record wey you set for cooking largest jollof rice for Naija style.
"That passion, strong head and creativity wey you use show your talent as celebrity chef for one of Nigeria best food for international stage, na him dey inspire people.
"Your cooking skill no just make our country proud, but don make whole world recognise am.
"With dis your win, you don show wetin young Nigerian women fit do if dem work hard, get strong mind and use better ideas.
"I dey pray make you and other Nigerian youth wey get big dreams still achieve greater things.
Congrats, Hilda Baci." She write.
CULTURE
1 minit wey yu go read
Nigeria First Lady praise Hilda Baci wey set new world record
For di message wey her office release, Madam Tinubu talk say: "I dey congratulate you well-well.”
Explore