Di FBI don release new video wey show di suspect wey dem say shoot one big US conservative activist, Charlie Kirk. For di video, dem see di suspect dey run for roof before e jump comot and enter bush wey dey near di area.
Authorities talk say di suspect, wey dem believe say be university pikin, wear black T-shirt wey get American flag and Converse shoe. Dem say na di kain thing wey fit helep identify am.
Police talk say dem dey process DNA evidence wey dem collect for di crime scene for Utah Valley University, where dem shoot Kirk wey be ally to US President Donald Trump, on Wednesday. Prosecutors dey plan to pursue death penalty once dem catch di suspect.
Investigators confirm say dem recover one high-powered rifle for di bush wey dey near di campus. Sources tell local media say police don identify one 'person of interest,' but dem never arrest anybody yet.
Di FBI don promise $100,000 reward for anybody wey fit give information wey go lead to di suspect capture. Police also release audio wey dem record just after di shooting, and investigators dey analyse di suspect pictures to see if dem fit get more clue.
Di killing of di 31-year-old Turning Point USA founder don make plenty people vex and condemn di act from different political sides.