South Sudan First Vice President, Riek Machar, dey face plenty serious charges wey fit carry heavy punishment, like life for prison or even death.
Bikos of dis mata, South Sudan President, Salva Kiir, for Thursday night, suspend Machar from him office "until court trial finish," na wetin di presidency tok.
Di announcement wey dem put for presidential decree, dem read am for di state-owned South Sudan Broadcasting Corporation (SSBC).
Dem also suspend di Petroleum Minister, Puot Kang Chol, wey be Machar close padi.
'Treason, crimes against humanity'
Earlier for Thursday, South Sudan Justice Minister, Joseph Geng Akech, tok say di First Vice President, Machar, go answer charges wey relate to treason, murder, and crimes against humanity.
For early March, one armed group from Machar ethnic Nuer community, wey dem dey call White Army, attack one military base for Nasir County, Upper Nile State, for di northeast of di kontri.
Di government tok say na Machar dey responsible and dem don charge am plus 20 other pipo with serious crimes, like conspiracy against di state and destruction of public property.
Di White Army overrun di military base for Nasir between March 3 and 7, 2025.
Machar political party deny di allegations
"Dis case dey send clear message: anybody wey commit badness against di pipo of South Sudan, against our armed forces, and against humanitarian workers go face di law, no matter di position or political power wey dem get," na wetin Justice Minister Joseph Geng Akech tok for Thursday.
Machar political party, Sudan Pipo Liberation Movement-in-Opposition (SPLM-IO), don tok many times say di First Vice President no get hand for di Nasir military base attack.