19 pipo die for Kerala, wey dey South India, for 2025 sake of one disease wey dem dey call ‘amoebic meningoencephalitis’ (PAM), wey dey chop brain. Na di Health Commissioner for di state, Veena George, talk dis one.
George tok say di disease don catch 69 pipo for di same year.
Di state don declare emergency as di disease dey spread, na wetin di state TV station, DD, report.
Di disease, wey dem dey call ‘Naegleria fowleri,’ no too common, and e dey affect pipo wey dey swim for dirty water, play for water parks, or other water enjoyment places. Na wetin di US Center for Disease Control (CDC) tok.
Dem dey call di disease ‘Amoeba wey dey chop brain’ because e fit enter di brain, destroy nerves and di brain tissue. Na wetin CDC website explain.
No be today di disease start for di state. Di first time wey dem notice am na for 2016.
Kerala Health Department tok say, “we don see PAM cases for different areas inside di state for di past 10 years.”