WORLD
2 minit wey yu go read
Senegal catch wooden boat wey carry 112 migrants wey dey try Japa
Di mayor for Dakar Ouakam area, tok say na local fishermen see di wooden pirogue wey no get engine, come alert authorities.
Senegal catch wooden boat wey carry 112 migrants wey dey try Japa
Coast guard dey always face wahala with pipo wey dey comot West Africa go Europe anyhow, especially through Atlantic Ocean go Spain. / Reuters
17 Septemba 2025

Senegalese authorities don catch 112 migrants wey dey inside one long wooden fishing boat dem dey call pirogue, for near Dakar coast on Tuesday, as dem dey try waka go Europe through di dangerous Atlantic Ocean route, na wetin officials tok.

Abdoul Aziz Gueye, wey be di mayor for Dakar Ouakam area, tok say na local fishermen see di wooden pirogue wey no get engine, come alert di authorities.

"Di fishermen help dem with one motor wey dem use take near di shore before di marines come catch dem," Gueye tok, add say all di people wey dey inside na young men.

Dem don start investigation to find out where di boat from come and why e no get engine, Gueye add.

One of di migrants, wey dey sit down for Ouakam beach under di watch of Senegalese gendarmes, tok give Reuters say dem group na from one neighbouring country and dem don dey for sea for five days.

Di waka wey people dey do from West Africa go Europe, especially through di Atlantic route go Spain Canary Islands, na serious wahala wey di regional coastguards dey face.

Senegalese authorities don dey do more patrols for recent years to stop illegal migration.