POLITICS
2 minit wey yu go read
African Union don suspend Madagascar afta coup wey happun
Di Chairperson of di AU Commission, Mahamoud Ali Youssouf, tok say di suspension don take effect immediately.
African Union don suspend Madagascar afta coup wey happun
Randrianirina say dem go soon swear am in as Presido.
16 Oktoba 2025

Di African Union don suspend Madagascar just few hours afta di leader of one military coup tok say im go swear in as di kontri president.

"Di rule of law suppose pass di rule of force," na wetin AU Commission Chairperson Mahamoud Ali Youssouf tok for one statement on Wednesday, as e announce say di suspension go start immediately.

President Andry Rajoelina run comot di kontri because e dey fear for im safety afta weeks of anti-goment protest wey dem dey call "Gen-Z" protest. Di protest join military pipo wey dey vex about di water and electricity shortage, and di way Rajoelina sack di whole goment only make di mata worse as pipo dey shout say make e resign.

From one secret location, Rajoelina try use decree dissolve di National Assembly, but di Assembly no gree. Dem vote to impeach am on Tuesday.

Shortly afta dat, Colonel Michael Randrianirina and im elite CAPSAT military unit announce say di military don take over, dissolve most of di state institutions, and dem go put one transitional goment.

No more lives suppose loss

Randrianirina tell reporters on Wednesday morning say e go soon swear in as president afta di High Constitutional Court invite am to serve di role.

Di same Wednesday, di Southern African Development Community (SADC) pick one panel of elders to try calm di tension for di former French colony.

Malawian President Peter Mutharika, wey be di chairperson of di SADC Organ on Politics, Defence and Security Cooperation, tok for statement say former Malawian President Joyce Banda go lead di panel to make sure say peace, dialogue and calm dey for di island kontri.

"No more Malagasy lives suppose loss because of di unrest," na wetin Mutharika tok.