Di African Union don hail di 92-year-old President Paul Biya afta im win im eighth term for di October 12 election for Cameroon, but dem still condemn di way dem handle di protest wey follow di result, wey lead to di death of at least four people.
AU chair Mahmoud Ali Youssouf talk say im dey 'seriously worry' about di tori of violence, repression and di arrest of protesters and political people wey relate to di election result. Di organisation tok dis one for statement wey dem post for social media.
“Im dey beg di Cameroonian authorities make dem put national dialogue and consultation with all di political stakeholders for front burner, so dem fit reach agreement for di spirit of national unity, peace and collective security,” di statement add.
Cameroon government on Tuesday don confirm say people die during di protest, but dem blame di opposition leader for di deaths.
Four people don die for di central African country since di protesters enter street to vex say Biya, wey don dey for power since 1982, don win eighth term for di election wey dem do dis month.
Di opposition dey claim say dem win di election. Former government minister Issa Tchiroma Bakary dey insist say na im win di vote, and hundreds of people don answer im call to protest for different Cameroonian cities afta di election. Police don scatter di small-small protests wey happen.
“Illegal demonstrations don cause loss of life and destruction of public and private property,” na wetin Territorial Administration Minister Paul Atanga Nji tok for press conference, but im no give more details.
Im blame Tchiroma say na im dey call for 'insurrection', and im talk say di ex-minister supporters organise violent protests. Dis one lead to fire, stealing and looting for different cities like Dschang for west, Ngon for central Cameroon, and Guider and Garoua for north.
“For di middle of dis criminal attacks... some of di attackers lose dia life,” na wetin Atanga Nji tok.
Dem don start investigation on top di opposition leader as di minister talk say di man don commit plenty offences wey di law no go gree.
Di minister still talk say some security people wound well-well during di fight with di protesters.















