Di presido of Cameroon, Paul Biya, wey reach 92 years, win di presidential election for di eighth time wit 53.7 percent of di votes wey dem cast, according to di result wey Constitutional Council announce on Monday.
Di opposition candidate and former minister, Issa Tchiroma Bakary, come second wit 35.2 percent, na wetin di council tok. Tchiroma bin don declare himself as di winner two days afta di election wey dem do on October 12, and e call for protest.
Four people bin die on Sunday afta clash happen between security officers and opposition supporters for di commercial city of Douala, na wetin di city governor tok.
Protesters wey AFP news agency interview tok say di security officers first use tear gas, before dem start to shoot live bullets.
Since last week, supporters of Issa Tchiroma, wey claim say e get 54.8 percent of di votes while Biya get 31.3 percent, don dey for street dey defend di claim say na him win.
Plenty experts bin predict say Biya, wey be di oldest sitting president for di world, go win di seven-year term again.
Biya na di second president wey don rule Cameroon since dem get independence from France for 1960.















