POLITICS
2 minit wey yu go read
Zimbabwe parliament say sorry afta Presido Mnangagwa use torchlight to read speech
Di clerk of parliament blame di loss of power to one faulty electricity generator wey dey supply power to di building.
Zimbabwe parliament say sorry afta Presido Mnangagwa use torchlight to read speech
President Emmerson Mnangagwa for parliament wia di tin happun.
30 Oktoba 2025

Zimbabwe parliament don beg President Emmerson Mnangagwa and di whole nation afta power wahala cut im state of di nation tok for parliament on Tuesday.

Di president bin dey use torchlight wey one aide hold for am to finish part of hin speech afta darkness cover di parliament.

For one statement, di clerk of parliament talk say na di generator wey dey supply di building power wey get fault cause di wahala. E still talk say backup power from Zimbabwe Electricity Supply Authority (Zesa) dey ready, but e no tok if e work well.

‘Faulty circuit breaker’

“When di power off, di generator bin still dey run but e no dey supply power. Di first check wey we do show say na di circuit breaker wey dey supply di load wey trip,” di Clerk of Parliament Kennedy Chokuda tok for one statement.

E still tok say di process to bring back di power take pass wetin dem expect, and na why part of di president speech bin dey without light. Dem don start investigation and go put measures to make sure say dis kain tin no go happen again.

Zimbabwe parliament don get history of power wahala during big events. For November last year, President Mnangagwa, Vice-President Constantino Chiwenga and di lawmakers bin sit for darkness as di finance minister dey read di budget speech.

President economic outlook

Di president speech on Tuesday show di plans and strategies wey go shape Zimbabwe economic future. “Di national economy go grow by 6.6% for 2025, based on di recovery for di agricultural sector, with beta harvest of tobacco, maize and wheat, plus other crops,” e tok, according to di clips wey di ministry of information share.

Zimbabwe new parliament building na China build am and dem fund am through grant, dem hand am over to di government for October 2023.