Nigerian chef, Hilda Baci, don get recognition for cooking di biggest jollof rice meal wey pipo don ever see.
Guinness World Records tok on Monday say di food wey Baci cook for Lagos, Nigeria commercial city, on September 12, weigh 8,780 kilogrammes.
Dem use at least 168 kilogrammes of goat meat for di cooking.
"Nigerian chef Hilda Baci don enter di record books again afta she start di record fever for Africa," Guinness World Records tok for dia Instagram post.
Nine hours of cooking
With di help of Gino Nigeria brand, Hilda cook di biggest Nigerian style jollof rice, Guinness World Records add. Ten oda chefs follow Baci to set di world record.
According to Baci, wey be 28 years old, e take "nine hours of fire, passion, and teamwork" plus 1,200 kilogrammes of gas to prepare di 16,600 plates of rice wey dem serve "with joy, love and community."
Afta di big meal ready, dem share am give people for Victoria Island, di place wey dem cook di food.
Jollof rice na popular food for West Africa. Normally, dem dey make am with rice, tomatoes, and different spices. Most times, dem dey pair am with meat or seafood.
Another world record for Baci
Di ingredients and di way dem dey prepare jollof rice fit change from one country to another.
For May 2023, Baci collect Guinness World Record for di longest cooking session wey last 93 hours and 11 minutes.
But later, Irish chef Alan Fisher pass her own record as e cook for 119 hours and 57 minutes for November 2023.
Di current record-holder na Australia's Evette Quoibia, wey cook for 140 hours and 11 minutes for May 2025.