WORLD
2 minit wey yu go read
Nigerian goment don cancel parade to celebrate Independence day
Di programs wey go still hold na di President speech, cultural shows, and final stage of National Campus Debate wey students dey do.
Nigerian goment don cancel parade to celebrate Independence day
Nigeria dey normally celebrate dia independence wit plenty programs.
30 Septemba 2025

Federal Government don cancel dat parade wey dem arrange before to celebrate Nigeria independence for Wednesday, October 1.

Dem announce am for one statement wey come from di Office of di Secretary to di Government of di Federation on Monday.

For di statement wey di Director of Information, Segun Imohiosen, sign, dem talk say: "Di Federal Government want make everybody know say dem don cancel di Independence Anniversary parade wey dem plan before for Wednesday, 1st October. But make nobody think say because of dis cancellation, di anniversary no important again."

Dem still talk say government dey sorry if dis cancellation cause any wahala for anybody, but make we know say all di oda programs wey dem arrange for di anniversary go still hold. Di programs wey go still hold na di President speech, cultural shows, and di final stage of dat National Campus Debate wey students dey do.

Di statement still add say: "Federal Government dey very happy say Nigerians, all di ambassadors and dia guests sabi wetin dey happen. Dem beg all of us to continue to support di 'Renewed Hope Agenda' wey dis government dey talk about."

As di SGF, Senator George Akume dey talk with journalists for Abuja on Monday, e explain say Independence Day no be just for celebration, but na time to think wella about our country and to love am better.

Akume talk say: "Independence Day na one chance to look how far we don reach as country, to celebrate how we strong and to promise ourselves say we go still dey together, live in peace and make di country better."