WORLD
1 minit wey yu go read
Nigerian Presido Tinubu meet with im new military ogas
Di Presidency yarn say di meeting na mainly about how to secure di kontri well well.
Nigerian Presido Tinubu meet with im new military ogas
Di Presido announce military changes last week.
28 Oktoba 2025

Presido Bola Tinubu don hold meeting with all di new military service chiefs for inside Presidential Villa for Abuja. Dem no allow anybody hear wetin dem talk.

Di Presidency talk say di meeting na mainly about how to secure di country well well and how all di different armed forces go fit work together.

According to top-top pipo for government, dis meeting na chance for di Presido to tell di new military ogas wetin e expect from dem.

E dey specifically about how to fight terrorists, manage security for inside di kontri, and make sure all di army, navy and air force dey work together as one body.

Pipo dey see dis meeting as di real beginning of new strategy for how dis government wan take tackle security matter. Dem dey expect say di new Service Chiefs go now carry di Presido plan comot for paper, make am work for ground.