WORLD
1 minit wey yu go read
Yamal go spend $16m to buy house wey Pique and Shakira bin dey stay
Lamine Yamal go buy di house of former Barcelona player, Gerard Pique, wey im and im former wife, Shakira bin dey stay before dia divorce.
Yamal go spend $16m to buy house wey Pique and Shakira bin dey stay
Di 18 year old na one of most talented footballers wey dey dis world.
28 Oktoba 2025

Young player for Barcelona, Lamine Yamal, don ready to buy di house we former Barcelona player, Gerard Pique, bin dey live with im ex-wife, di popular singer Shakira, before dem separate for 2022.

Di big house wey worth $16 million get three houses inside, swimming pool, tennis court, and studio for recording video and voice.

If Yamal, wey be Spanish, buy di house and move in with im girlfriend, di Argentine singer Nick Nicole, wey senior am with seven years, e go resemble wetin Pique do. Pique, wey also be Spanish, bin dey with Shakira, wey be Colombian and senior am with ten years.

Yamal dey enjoy beta fame and money from di new contract wey e sign with Barca till 2031. E still dey make money from endorsement deals.

Before now, di young player don buy house for im mama and grandma. E even talk before say e dey live with im mama for one house.

Now wey e don reach 18 years, e fit decide to start to dey live with im girlfriend, Nicole, wey don become important person for im life now.