Billionaire Elon Musk, di richest pesin for di world, don almost reach halfway to become di first trillionaire for di planet, na wetin Forbes magazine tok.
Di Tesla and SpaceX CEO na di first pesin wey don get net worth of $500 billion, even if na small time, as di shares for im electric car company bounce back after di wahala wey e face for politics, plus other gains wey e make.
Di 54-year-old net worth reach $500.1 billion on Wednesday before e drop small go $499.1 billion, na wetin di publication Real-Time Billionaires tracker show.
After Musk for di list na Oracle CEO Larry Ellison wey get net worth of $350.7 billion, followed by Meta CEO Mark Zuckerberg wey get $245.8 billion, according to di Forbes list.
After Musk finish from University of Pennsylvania and drop out from Stanford University, e make im first millions when e sell one online publishing software company to US computer maker Compaq for more than $300 million for 1999.


















