Palestinians and Israelis dey celebrate as Hamas and Israel agree on first part of Gaza deal
WAR FOR GAZA
1 minit wey yu go read
Palestinians and Israelis dey celebrate as Hamas and Israel agree on first part of Gaza dealDi Palestinians go out to celebrate di deal inside di ruins of Gaza, and di Israelis flood di streets of Israel to show say dem happy.
Palestinians for Gaza comot inside di ruins of di area to celebrate di deal.
9 Oktoba 2025

Afta two long years of wahala, destruction, and killing, di US President don announce say Hamas and Israel don agree for di first phase of im peace plan.

Di announcement make Palestinians wey dey for di besieged Gaza happy well well, dem waka go di ruins of di blockaded area to celebrate di agreement.

Di same way, Israelis, including di families of di pipo wey dem capture, full street to celebrate di deal wey aim to stop di wahala and killing for Gaza.

Here be some of di pictures: