Türkiye dey celebrate di 102nd anniversary of di founding of dia Republic, as President Recep Tayyip Erdogan call for unity, resilience, and make dem continue to push for di country “Century of Türkiye” vision.
For one message wey dem release on Wednesday, Erdogan hail di citizens for Türkiye and di ones wey dey abroad on top Republic Day, e still send greetings to Turkish Cypriots and “all di pipo wey dey happy with us.”
“For dis proud day, I dey congratulate all our 86 million citizens, di Turkish Cypriot pipo, and our brothers and sisters wey dey live for abroad,” na wetin e talk. “I dey remember with respect di heroes wey use dia blood and life make dis land our homeland.”
Erdogan still salute di founder of di Republic, Mustafa Kemal Atatürk, and di members of di Grand National Assembly wey lead di War of Independence.
‘Strong nation with deep-rooted traditions’
E talk say Türkiye na “both strong nation and state wey get deep-rooted traditions,” as e emphasize di country determination to protect dia unity and sovereignty.
Di president talk say Türkiye dey make progress for every area — from defence and economy to energy and diplomacy — under di “Century of Türkiye” vision, and e promise say dem go continue to build “great, strong, and prosperous Türkiye.”
Erdogan still promise say dem go continue to rebuild di areas wey February 2023 earthquake scatter, as e talk say di government plan to deliver 453,000 new houses before di year go finish.
E still confirm Türkiye commitment to peace and stability, as e talk say di country dey waka “step by step toward a terror-free Türkiye” and dem dey continue to defend justice and humanity for di middle of global wahala, including di one for Gaza and Palestine.
“Together, we go build great, strong, and prosperous Türkiye — wey go be leader for di region and respected power for di world,” na wetin Erdogan talk as dem mark di Republic 102nd anniversary.



























