US Presido Donald Trump don talk say di Turkish Presido, Recep Tayyip Erdogan, fit help end di war wey dey between Russia and Ukraine.
“Erdogan fit do am,” Trump yarn reporters for Air Force One as im dey go White House from Egypt on Monday. Dem bin ask am whether leaders, especially Erdogan, fit help for di war between Russia and Ukraine.
“Russia dey respect am,” Trump add.
Earlier on Monday, Trump and Egyptian Presido Abdel Fattah el Sisi gather more than 20 world leaders, including Presido Erdogan, for di Egyptian resort town of Sharm El-Sheikh for one summit to sign Gaza ceasefire agreement.
Türkiye dey continue im efforts to end di Russia-Ukraine war wey start for February 2022. Ankara don dey beg Kiev and Moscow to stop di fight through negotiation, and dem talk say dem ready to do anytin, including mediation, to make peace possible.
Meeting with Zelenskyy
Later, Trump confirm say im go meet Ukraine Presido Volodymyr Zelenskyy for White House on Friday.
“I think so, yeah,” di US presido talk as im dey return from Middle East, when one reporter ask am whether im go host di Ukrainian leader for White House on Friday.
Earlier dat day, Zelenskyy talk say one Ukrainian delegation don travel go US for some meetings, and im confirm say im go meet Trump on Friday.
“I go also get di chance to waka go Washington and meet Presido Trump on Friday,” Zelenskyy talk for X.
“I believe say we go discuss some steps wey I wan propose. I dey thank Presido Trump for our discussion and di support wey im dey give.”
Zelenskyy talk say di main focus of di visit na air defence and long-range capabilities “wey go help put pressure on Russia to bring peace.”



























