Rivers State administrator, Vice-Admiral Ibok-Ete Ibas suppose hand over power give Govnor Siminalayi Fubara afta di six months wey dem dey under state of emergency expire.
Di state of emergency wey President Bola Tinubu declare na because of di political and security wahala we bin dey happun for Rivers State.
Di kasala start as di long-time fight between Govnor Siminalayi Fubara and di State House of Assembly escalate, especially afta di Assembly building collapse for 2023.
Make we look some oda times wey Nigeria don declare dis kain state of emergency before.
Joshua Dariye
For dat time, Plateau State dey face religious and tribal wahala, especially for Yelwa–Shendam and di surrounding areas. Di fight between communities cause di death of hundreds of people, burning of villages, and scatter plenty people comot dia houses.
Former Nigeria President Olusegun Obasanjo declare state of emergency for Plateau State for May 2004.
Di Federal Government accuse Joshua Dariye say e no fit handle di wahala well and e dey partial for di way e dey run di matter.
Because of dat, President Obasanjo announce di state of emergency, suspend Dariye from im position, and appoint General Chris Alli (we don retire) as di Administrator of Plateau State for six months.
During di interim government, di Administrator take over from di elected state government, dissolve di State House of Assembly, and try bring peace before dem return power back to Joshua Dariye afta di suspension period end.
Ayodele Fayose
State of emergency dey declared for Ekiti State on October 19, 2006, during di time of President Olusegun Obasanjo.
Dem accuse Govnor Ayodele Fayose of misconduct, corruption, and using government office for personal gain.
On top dat, di state dey face political wahala and violence, including allegation say Fayose get hand for political killings.
As di tension rise, di Ekiti State House of Assembly try impeach am, but di move cause more kasala wey make governance for di state scatter.
To respond to di matter, President Obasanjo declare state of emergency for di state, suspend di State Assembly and Fayose, and appoint General Adetunji Olurin (we don retire) as di Administrator until di situation calm down.
Siminalayi Fubara
For March 2025, President Bola Tinubu declare state of emergency for Rivers State because of di political and security wahala wey dey happen for di state.
Di kasala start as di long-time fight between Govnor Siminalayi Fubara and di State House of Assembly escalate, especially afta di Assembly building collapse for 2023.
Di lawmakers try impeach di Govnor, wey make di government stop to dey function because dem no fit agree on di state budget.
President Tinubu talk say di Rivers State government no fit manage governance and security well, so e use di power we di law give am under Section 305 of di 1999 Constitution of Nigeria to intervene.
E suspend Govnor Fubara, im deputy Ngozi Odu, and all di State Assembly members for six months, and appoint retired Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas as di special Administrator of di state.
Afta di six months Federal Government rule di state, on September 17, 2025, President Tinubu lift di state of emergency and return di Govnor, im deputy, and di lawmakers back to dia positions, wey bring di special measure to an end.