Cameroon goment arrest opposition pipo as election result wan comot
Among those wey dem arrest na Anicet Ekane, the president of the MANIDEM party, and Djeukam Tchameni, big figure for Union for Change group.
Goment for Cameroon don arrest about 30 politicians and activists wey dey support opposition presidential candidate, Issa Tchiroma.
Dis one na wetin him campaign team tok on Sunday, as tension dey rise before dem go announce di result of di October 12 election on Monday.
Among di people wey dem arrest, na Anicet Ekane, wey be di chairman of MANIDEM party, and Djeukam Tchameni, wey be big person for Union for Change group. Both of dem dey support Tchiroma for di election.
Di arrest happen as kasala dey burst between security people and Tchiroma supporters for di Central African country wey get plenty cocoa and oil. Tchiroma don call for nationwide protest on Sunday by 2:00 pm GMT.
Cameroon Minister of Interior, Paul Atanga Nji, confirm for press conference on Saturday say dem don arrest some people wey get hand for wetin him call "attempt to cause wahala," but him no mention names or how many people dem arrest.
Him tok say: "Di call wey some politicians wey dey hungry for power dey make for protest dey create insecurity and dey help to cause wahala."
For one message wey Tchiroma post for him Facebook page on Sunday, him deny di accusation say him dey cause wahala. Him still accuse some govment officials say dem try negotiate with some of di people wey dem arrest before dem carry dem go.
Him write: "Una no gree for di offer wey dem give una, now una dey arrest dem? So, when una dey try negotiate with dem, dem no be terrorist abi?"
Tchiroma, wey be former minister and former ally of President Paul Biya, don claim say na him win di election, and him no go accept any other result.
Protest don happen for many cities last week after some provisional results wey media report show say Biya dey likely to declare victory.
Biya, wey be 92 years old, don dey rule Cameroon since 1982. Him be di oldest president for di world now, and if Constitutional Council confirm him victory on Monday, him go fit continue to rule for another seven years.