Heavy rain cause landslide wey kill 24 pipo for India

Authorities dey mobilize help as dem tell tourists to stay put and afta flooding and landslides happen for eastern India

Members of di National Disaster Response Force dey comot stranded pipo using temporary zip line wey dem lay across one broken bridge.

Di number of pipo wey don die for India West Bengal state don reach 24 afta heavy rain cause big landslide and bridge collapse, na wetin officials tok.

West Bengal Governor, Mamata Banerjee, tok say di heavy rain wey fall sudden-sudden don make plenty area for North Bengal and South Bengal dey flooded.

For one post wey she put for X, she advise tourists for North Bengal say make dem stay where dem dey until di police fit carry dem comot safely.

Raju Bista, wey be parliamentarian for Darjeeling district, di area wey landslide happen, also confirm say 24 pipo don die for di region.

Prime Minister Narendra Modi tok say dem go provide all di "help wey dem fit give to di pipo wey di matter affect."

"E pain me well well say people don die because of di bridge wey collapse for Darjeeling. I dey send my condolence to di pipo wey lose dia loved ones. I pray make di pipo wey injure recover quick. We dey monitor di situation for Darjeeling and di areas around am because of di heavy rain and landslide," na wetin e write for X.