EFCC recover billions and arrest 7,000 pipo wey get case inside two years - Tinubu
Presido Tinubu tok say im goment no dey interfere wit di work of di anti-corruption agencies or di judiciary.
Presido Bola Tinubu of Nigeria don talk say EFCC, di agency wey dey fight corruption, don catch 7,000 pipo wey do bad tins and dem don recover property wey worth N500 billion naira for di two years wey e don dey power.
Tinubu talk dis one on Monday for one workshop wey EFCC organize for judges for di Nigerian Judicial Institute wey dey Abuja. E no dey di event but e send hin deputy, Kashim Shettima, to represent am. E talk say di figures show say imogoment dey serious for di fight against corruption and e dey give judiciary di freedom to do dia work well.
“EFCC don catch more than 7,000 pipo wey do bad tins for di first two years of my government and dem don recover property wey worth pass N500 billion naira,” na wetin Tinubu talk.
E still add say di property wey dem recover, dem dey use am for beta programs like student loan scheme and oda loan programs wey go help pipu.
Di presido talk say hin government no dey interfere for di work of EFCC or judiciary. E talk say dem dey free to do dia work as di constitution talk am.
“Nobody fit talk say dis government dey protect politicians because dem dey close to us or because dem dey our party,” na wetin Tinubu yarn.
“We don give judiciary and EFCC di freedom to do dia work as di law take talk am,” e add.
As e dey talk to di judiciary pipu for di workshop wey be di seventh edition, Tinubu agree say pipu dey vex say corruption cases dey take time for court, but dem dey quick quick finish cases wey concern internet fraud.
“Di theme of dis year workshop, ‘Improving Justice for Economic Crimes,’ go make plenty pipu reason di mata well. E dey happen for di time wey pipu dey vex say corruption cases dey slow for court, but dem dey rush internet fraud cases,” Tinubu talk.
“Pipo dey vex too for di kind judgment wey court dey give for big corruption cases, e dey make dem feel say di system dey cheat dem,” e add.
Tinubu beg judges make dem protect di integrity of di judiciary, wey e call di “last hope for everybody.”
“We fit get one Naija wey no get corruption if all of us dey do di right thing for where we dey,” na wetin Tinubu talk.