President of Mexico sue one man wey dey harass her for street

Di Mexican President, Claudia Sheinbaum, don file official complaint against one man wey sexually harass her on Tuesday, for one of di streets for Mexico City.

By
Di Presido say di man bin dey harass oda women.

Mexican Presido Claudia Sheinbaum say she decide carry case go court because she find out say di man wey harass am don also harass other women before dem catch am.

She talk say, "If I no carry di matter go court, wetin go happen to di other women for Mexico? If dem fit do dis kain thing to di president, wetin go happen to di rest women for our country?"

Dem don arrest di man, wey him name na Uriel Rivera, and dem hand am over to di office wey dey handle sexual crimes. For Mexico City, sexual harassment na crime wey law dey punish.

Video wey people share for social media show say di man waka go meet Shienbaum as she dey move with her supporters for di city center. Di man put him hand for her shoulder, touch her body anyhow, and even try kiss am before security people come stop am.

Di president talk say she no even know wetin happen until she watch di video. She talk say di man dey drunk and e fit be say e dey under drug influence. Even though di thing happen, she maintain her calm, behave well, and even snap picture with di man before security carry am commot.

Shienbaum talk say she go work on how dem go fit change di law for sexual harassment for Mexico. She explain say Mexico na federal country wey get 32 states, and each state get dia own criminal law. Some of dem no dey even talk clear about dis kain behavior.

Di Minister of Women Affairs, Citlalli Hernández, condemn di incident. She talk say di matter na example of how some men dey feel say dem fit enter women personal space anyhow like say e no mean anything.

Dis incident don make people dey talk again about how big di problem of sexual harassment dey for Mexico. UN Women data show say about 70% of Mexican women wey don pass 15 years don experience sexual harassment at least once for dia life.