Trump no take clear stand on whether Palestine go get dia own kontri

''I no dey tok about one state or two state or double state. We dey tok about di rebuilding of Gaza,'' na so di US president tok.

US Presido Donald Trump as e dey address di Knesset when e visit Israel.

US President Donald Trump no gree on Monday to support di two-state solution for di Israeli-Palestinian wahala, as e tok say im main focus now na to rebuild Gaza.

"I dey talk about sometin wey different. Wetin we dey talk na how to rebuild Gaza," Trump tok dis one to reporters for inside Air Force One as e dey return from Egypt. Dem bin ask am about wetin Egyptian President Abdel Fattah el Sisi tok about di two-state solution and independent Palestinian state.

"I no dey talk about one state or two state or double state. Wetin we dey talk na di rebuilding of Gaza," Trump add.

Earlier on Monday, Trump and Sisi gather more than 20 world leaders for di Egyptian resort town of Sharm el-Sheikh for one summit to sign ceasefire agreement for Gaza. Türkiye, Egypt, and Qatar go dey as guarantors for di deal.

"Plenty people like di one-state solution. Some people like di two-state solution. We go see how e go be. I never talk anything about dat one," Trump tok, as e add say e go dey work with other countries on di future plans for Gaza.

Trump announce on Wednesday say Israel and Hamas don agree to di first phase of one 20-point plan wey e bring out on September 29. Di plan na to bring ceasefire for Gaza, release all Israeli captives wey dey there in exchange for about 2,000 Palestinian prisoners, and make Israeli forces gradually comot from di whole Palestinian enclave.

Di first phase of di Gaza ceasefire agreement don start on Friday under Trump plan to end di two-year Israeli war for di enclave.

Di second phase of di plan na to create new government system for Gaza, form one security force wey go get Palestinians and troops from Arab and Muslim countries, and disarm Hamas.

Since October 2023, Israeli attacks don kill more than 67,800 Palestinians for Gaza, most of dem na women and children, and di place don almost turn unlivable.