Nigerian University deny say dem dey work to make nuclear weapon

Malam Auwalu Umar, wey be di Director of Public Affairs for di university, na im talk dis one for one statement wey e release.

Di university say di video wey dey circulate for social media na just to deceive pipo.

Ahmadu Bello University (ABU) wey dey northern Nigeria don deny one video wey dey waka for social media wey claim say di university dey involved for di production of nuclear weapon for di kontri.

Malam Auwalu Umar, wey be di Director of Public Affairs for di university, na im talk dis one for one statement wey e release.

Di director describe di video wey dem create wit AI technology as fake and say e dey try confuse people about Nigeria plan to use nuclear energy for peaceful purposes.

E talk say di video claim say some Nigerian scientists for di 1980s hide and dey work on how to upgrade uranium for Kaduna to di level wey dem fit use am produce weapon. Di video also talk say researchers from ABU collect materials to upgrade uranium from AQ Khan group for Pakistan.

Umar come add say di claim no get any base at all.

E explain say most of di ABU scientists wey dey Nuclear Energy Research and Training Centre (CERT) for di 1980s dey abroad dey study, so dem no fit dey involved for any uranium upgrade work.

Di director talk say ABU no get any connection wit AQ Khan group and dem no ever collect any material wey dem fit use to upgrade uranium to produce nuclear weapon.

E add say by 1987, di only nuclear equipment wey di university get na 14 MeV Neutron Generator, wey dem start to dey use for 1988.

Umar emphasize say all di nuclear activities for Nigeria dey open and na only for peaceful purposes, based on di international agreement of Nuclear Non-Proliferation Treaty (NPT) and Pelindaba Treaty, wey ban di production of nuclear weapons.