UN Chief dey 'highly concerned' about escalation and attacks on civilians for Sudan Al Fasher

Guterres condemn "anyhow attacks" and worsening humanitarian crisis for Al Fasher, e beg both sides for Sudan conflict to end di wahala and resume peace talks.

The UN chief repeat im call for immediate end to di wahalaand demand safe humanitarian access to all civilians.

Di UN Secretary-General, Antonio Guterres, don tok say im dey very worried about di violence wey dey increase for di Sudanese city of Al Fasher. E condemn wetin e call “anyhow attack” and “targeting of civilians.”

“Di Secretary-General strongly condemn di tori of how dem dey break international humanitarian law and human rights for Al Fasher — including anyhow attack on civilians, gender-based violence, attack wey dey base on tribe, and di destruction of civilian property,” na wetin UN spokesperson, Stephane Dujarric, tok for statement on Monday.

Guterres beg di Sudanese Armed Forces and di Rapid Support Forces (RSF) make dem “quickly start to dey work” with im personal envoy, Ramtane Lamamra, and take “sharp, clear steps to settle di matter through negotiation.”

E warn say Al Fasher and di area wey dey around am don turn to di center of wahala for over 18 months, as hundreds of thousands of civilians dey trapped under di RSF siege.

“Malnutrition, sickness, and violence dey kill people every day,” di statement tok.

“End di siege”

Di UN oga repeat im call make dem end di siege sharp sharp and make dem allow humanitarian help reach all di civilians wey need am. E still tok say di way weapons and fighters dey enter Sudan dey make di fight worse.

Al Fasher, wey be di capital of North Darfur, don dey see heavy fight for weeks between di army and di RSF. Di RSF don surround di city from five directions as dem dey try to capture am. Di RSF start di siege of Al Fasher on May 10, 2024.

Sudan don dey inside civil war since April 2023, when fight start between di army and di RSF, wey don kill thousands of people and scatter millions across di country.