Weather pipo yarn say rain, thunder go boku inside Nigeria for three days
NiMet yarn say for di North, dem dey expect thunder for some areas, and small rain go fall for parts of Adamawa and Taraba.
Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don tok say from Monday reach Wednesday, rain and thunder go dey for all parts of Nigeria.
For di weather report wey dem release for Abuja on Sunday, NiMet taloksay for Monday morning for di North, dem dey expect thunder for some areas, and small rain go fall for parts of Adamawa and Taraba.
Later for dat same day, thunder and small rain go still fall for parts of Kaduna, Gombe, Kebbi, Zamfara, Adamawa, Bauchi, Southern Borno and Taraba.
For di Middle Belt area, sky go dey cloudy but sun go still shine small. For morning time, thunder and small rain show for parts of Nasarawa, Abuja (FCT), and Niger state.
But for afternoon and evening time, thunder and better rain go fall for plenty parts of dat area.
For di South, NiMet talk say sky go dey cloudy with small sunshine. For morning, dem dey expect thunder and small rain for parts of Ebonyi, Abia, Imo, Lagos, Delta, Bayelsa, Rivers, Cross River and Akwa Ibom.
Later for di day, thunder and better rain go fall for many places for di South.
NiMet still tok say for Monday for di North, sky go dey cloudy with small sun, and thunder go still dey for some areas with small rain for parts of Taraba and Adamawa for di morning.