Nigeria Presido remove Sanda name and some oda big criminals from pardon list

Di pardon wey di Presido give 175 pipo wey court convict bin cause plenti wahala for di whole kontri.

Di pardon list cause plenty tok tok across Nigeria.

Presido Bola Ahmed Tinubu of Nigeria don remove some names from di list of pipo wey e give pardon for di beginning of dis month.

Di pardon wey Presido give 175 pipo wey court don convict for di crimes wey dem commit don cause plenty tok-tok for di whole country.

Wetin really catch pipo attention na say some of di names for di list na pipo wey commit big-big crimes, like drug barons, kidnappers, killers, illegal miners, and di ones wey dey chop bribe anyhow.

But di statement wey come from di Presido office on Wednesday talk say after dem consult di National Council of State and hear wetin pipo dey talk about di matter, Presido Tinubu don order make dem review di list of di pipo wey dem give pardon under di power wey di 1999 Constitution Section 175 (1) and (2) give am.

“Dem don remove di names of pipo wey commit big crimes like kidnapping for ransom, drug trafficking, human trafficking, fraud, illegal possession or use of arms, and other similar crimes from di list,” di statement tok.

Change for di punishment

Di Presido office still add say some of di pipo wey dem first give pardon, dem don change am to reduce di punishment wey dem get before.

“Dis step dey necessary because of di seriousness of some crimes and di impact wey dem get on security, plus di need to protect di victims and di society as a whole.

“E still dey important to boost di morale of security agencies and follow wetin dey necessary for all di parties involved,” di statement wey Bayo Onanuga, di Special Adviser to di Presido on Media and Strategy, tok.

Dem consider di justice system wey involve three sides – di accused, di victim, and di society – as dem dey review di pardon.

Di list of di pipo wey qualify for di pardon don already go di Nigerian Correctional Service for dem to carry out di release based on di signed documents, as di Presido office tok.

Out of di 175 pipo wey Presido Tinubu first give pardon, dem don remove 141 names, so now na only 34 pipo remain for di new list, and Maryam Sanda no dey among dem. She be di woman wey court sentence to death for killing her husband.

For di 34 pipo, dem don pardon 15 completely, change death sentence to life imprisonment for four pipo, and reduce di punishment for di remaining 15.

On top dat one, Presido don order make dem quickly move di Secretariat of di Advisory Committee on Prerogative of Mercy from di Federal Ministry of Special Duties to di Federal Ministry of Justice.

Di statement tok say e do dis one to make sure say di future actions go match wetin pipo dey expect and follow di best practices.

Presido Tinubu still order di Attorney General of di Federation to bring out di correct steps for using di power of mercy, including mandatory consultation with di relevant prosecuting agencies.

Dis one go make sure say na only di pipo wey meet di legal and procedural requirements go benefit from di release documents. Di Presido appreciate di contributions of stakeholders and di public for dis matter.

Presido Tinubu still re-emphasize him government commitment to reform di judiciary sector and improve di justice system for Naija.