US vice president dey urge Netanyahu to give Gaza ceasefire 'a chance'
Di Israeli prime minister don show say e dey open to Vance call to maintain Gaza ceasefire and move forward with di next steps of di agreement, according to sources.
US Vice President JD Vance don reportedly tell Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu make e give di Gaza ceasefire agreement "a chance."
Israel Channel 12 tok say dem hear from both US and Israeli officials say for di meeting wey Vance get wit Netanyahu, e tell am: "Give di deal a chance and give us time to make things happen."
Netanyahu reply Vance say e dey ready to give di agreement a chance.
"I sef wan make di agreement work," na wetin e tok according to wetin officials wey sabi di matter yarn.
One American official wey follow for di meeting tok say Netanyahu show say e dey open to wetin Vance dey talk about di need to maintain di ceasefire and move forward wit di next steps of di agreement.
Di official still tok say di US government dey try gather economic, military and diplomatic support from Arab countries for di international force wey dem wan set up and deploy for Gaza, plus di peace council wey go help raise money to rebuild Gaza.
Vance, wey dey Israel for official visit, meet Netanyahu on Wednesday for West Jerusalem.