Erdogan for UNGA: 'No be war dey Gaza, na genocide’
Di Turkish president don beg say di whole world need to take action as Israel dey attack Gaza for almost two years, e say one pikin dey die every hour for 23 months.
Turkish President Recep Tayyip Erdogan don give one strong tok for United Nations General Assembly wey happen for New York, as e accuse Israel say dem dey do genocide for Gaza and e call make di international community act quick quick to stop di bloodshed.
“For all of us eye, genocide don dey happen for Gaza for more than 700 days,” na wetin Erdogan tok on Tuesday.
“For di past 23 months, Israel don dey kill one pikin every hour. Dis no be just numbers; each one na life, na innocent person.”
Erdogan tok say di humanitarian wahala wey dey happen for Gaza no get rival for modern history, as e describe how small pikin dem as young as two or three dey lose dia hand or leg without anaesthesia.
“Dis na di lowest point of humanity,” e tok give world leaders. “No be war dey happen for Gaza, no be two sides dey fight. Dis na invasion, genocide, and policy of mass killing.”
‘I dey tok for di Palestinian people’
Di Turkish president thank di countries wey don recognise di State of Palestine and e beg others make dem “act sharp sharp.”
E express regret say Palestinian President Mahmoud Abbas no dey New York, as e stress say Türkiye dey tok “on behalf of di Palestinian people, wey dia voice dey silenced.”
Erdogan call for immediate ceasefire for Gaza, free humanitarian access, and make dem hold Israel accountable for wetin e call “genocide crew.”
E accuse Israel say dem dey expand dia aggression pass Gaza and di occupied West Bank go reach Syria, Iran, Yemen, Lebanon and Qatar, wey fit scatter di peace for di region.
“Dem dey obsessed with di idea of promised land, di Israeli government dey spoil di peace for di region and humanity achievement with dia expansionist policy,” Erdogan tok, as e add say Prime Minister Benjamin Netanyahu “no get plan for peace or to free hostages.”
‘Stand with di oppressed Palestinians’
Di Turkish leader beg world leaders make dem stand “gidigba with di oppressed Palestinians today for di name of humanity,” as e argue say Israeli attack don wipe out di most basic human rights, including women and children rights, freedom of expression, equality, and justice.
“Peace fit dey for world where pikin dey die because dem no get food or medicine?” Erdogan ask. “Humanity never see dis kain wickedness for di last century.”