Trump no dey for di ballot: US president react say Democrats win key elections

Democrats win di New York City mayoral race and di governor races for New Jersey and Virginia.

By
Trump bin endorse former New York govnor Andrew Cuomo for mayor.

US President Donald Trump don react to di Democrats’ win for di big election wey happen on Tuesday, including di mayor race for New York City wey many people dey watch well. E talk say di reason why Republican Party no perform well na because e name no dey di ballot and di long government shutdown.

'TRUMP NO DEY DI BALLOT, AND SHUTDOWN, NA DI TWO REASON WHY REPUBLICANS LOSE ELECTION TONIGHT,' na wetin Pollsters talk,” di president yarn for him Truth Social platform on Wednesday.

Democrats win di New York City mayor race, di governor race for New Jersey and Virginia, plus California Proposition 50 wey concern redistricting. Dis na di first big win wey Democrats don get since Trump start him second term for January dis year.

Zohran Mamdani don become di mayor of New York City, making am di first Muslim and South Asian wey go hold di office, according to di unofficial results.

Former Rep. Abigail Spanberger go become di next governor of Virginia – and di first woman wey go be di chief executive for di state – while Rep. Mikie Sherrill win di New Jersey governor office.

“New York go still remain city of immigrants”

Voters for di Democratic state of California approve new congressional map wey dem design to counter Trump plan to help Republicans get better chance for next year midterm elections.

Trump bin support former New York Governor Andrew Cuomo, wey run for mayor as independent.

For him victory speech on Tuesday night, Mamdani talk to di president, e say: “Donald Trump, since I sabi say you dey watch, I get four words for you: turn di volume up.”

E come add: “New York go still remain city of immigrants, city wey immigrants build, powered by immigrants, and as from tonight led by immigrant … So hear me, President Trump, when I talk say dis one: to reach any of us, you go first pass through all of us.”