2026 WCQ: Morocco na host as four African nations battle for one spot
Nigeria, Cameroon, DR Congo, and Gabon go play semi-finals and then one final. Di winner go represent Africa for di FIFA playoff tournament.
Democratic Republic of Congo (DRC), Cameroon, Gabon and Nigeria go contest continental playoffs for dis international break.
Three matches go happen, na knockout system — two semi-finals and one final. The semi-finals go hold on Thursday 13 November and the final go be on Sunday 16 November.
Nigeria Super Eagles go play Gabon Panthères for Prince Moulay El Hassan stadium for Rabat by 16:00 GMT on Thursday.
CameroonIndomitable Lions go face Leopards of the RDC for El Barid stadium, Rabat, by 19:00 GMT just hours after di Nigeria game .
The final go play 16 November 2025 by 19:00 GMT for Prince Moulay El Hassan stadium.
Make una sabi, nine African teams don qualify straight for the World Cup wey go hold for Canada, United States and Mexico in 2026.
One last African team go get chance to play for the FIFA playoff tournament; after that tournament dem go know two additional teams wey go qualify.
Dis playoff go gather six teams.