Fuel shortage fears dey Nigeria as oil workers continue dia strike
Di wahala start on Friday wen Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria (PENGASSAN) accuse one refinery say dem sack 800 local workers.
One strike wey oil workers union dey do dey threaten to scatter fuel supply for Nigeria as goment dey try settle di mata since Tuesday.
Plenty pipo for di kontri dey rush to get fuel wey dem go use for some days as dem no know how tins fit be.
Di union say di strike na because some of dia workers for Dangote Refinery join union, di oganisation come sack and replace dem wit 2,000 workers from India.
Di refinery talk say di accusation na "complete lie" and say na only small number of workers dem sack because of "sabotage", but dem no talk di exact number.
PENGASSAN come declare strike and talk say dem go stop crude oil and gas from reaching di refinery – but Dangote don carry di mata go court.
Local tori people talk say on Monday, di PENGASSAN workers wey dey strike block di offices of Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) – di government oil company – plus di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission and di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority.
One Dangote spokesperson confirm give AFP say government dey try mediate di mata as of Tuesday.
Before Dangote refinery open last year, wey fit process 650,000 barrels per day, Nigeria dey import almost all di petrol wey di country dey use, even though we be big oil producer.
Di Dangote refinery don help reduce petrol price for consumers and e don shake di oil sector for Nigeria.
Recently, di refinery start to use dia own natural gas-powered trucks to distribute petrol for di country, but dis one cause wahala wit fuel tanker drivers' union for September. Di union accuse di company say dem dey hire new drivers on top condition say dem no go join union.
Di refinery don deny di accusation.