Madagascar new leader say e go tok with African Union afta dia suspension

Randrianirina still tok say dem go swear am in as president on Friday for one ceremony wey di High Constitutional Court go handle for di capital, Antananarivo.

Randrianirina say dem go swear am in as Presido on Friday / Reuters

Di military coup leader for Madagascar, Colonel Michael Randrianirina, don talk say im dey ready to yarn wit di African Union. Dis one dey come afta di African Union suspend di kontri membership afta President Andry Rajoelina bin comot for power.

"Di decision no surprise us. But from now, we go dey do backdoor negotiation. We go see as di mata go waka," Randrianirina tok dis one for press conference wey happen on Thursday.

Randrianirina still tok say dem go swear am in as president on Friday for one ceremony wey di High Constitutional Court go handle for di capital, Antananarivo.

But di UN Secretary-General, Antonio Guterres, no gree wit di way wey di government change hand. Di same Thursday, im condemn wetin im call unconstitutional change of government for di island kontri, and im dey call for di return to constitutional order and rule of law.

"I condemn di unconstitutional change of government for Madagascar and I dey call for di return to constitutional order and rule of law," Guterres tok for one statement.

"I dey encourage all di Malagasy people, including di youth, make dem join hand to solve di wahala wey dey cause di instability for di kontri," im add.

Guterres still tok say di UN ready to support di kontri effort to bring back constitutional order.

Meanwhile, Rajoelina, wey lawmakers impeach dis week afta im run comot from di kontri because im dey fear say dem wan assassinate am, don also condemn di takeover by Randrianirina. Di wahala bin start afta weeks of youth-led protests and military rebellion.