Japan PM go nominate Trump for Nobel Peace Prize: White House

Presido Trump meet Prime Minister Takaichi for Tokyo, e declare say US-Japan relations "go strong pass before."

Japan PM go nominate Trump for Nobel Peace Prize: White House

Japan Prime Minister, Sanae Takaichi, don talk say she go nominate US President, Donald Trump, for di Nobel Peace Prize, na wetin di White House yarn on Tuesday.

Trump don dey focus well-well on di Nobel Prize since im come back to power for January, as im dey claim say im don end plenty conflicts for di world.

Before-before, na some countries like Pakistan, Azerbaijan, and Cambodia don nominate Trump for di prize.

Takaichi meet Trump on Tuesday morning for Tokyo, where dem discuss economic and security mata dem.

"For dis short time, di world don start to enjoy more peace," Takaichi yarn reporters on Tuesday.

"Me sef, I dey impressed and inspired by you, Mr President," Takaichi add.

Bilateral ties go strong well-well — Trump

Trump talk on Tuesday say di relationship between US and Japan go reach di strongest level after im meet Takaichi for Tokyo.

"I don always get love and respect for Japan, and I fit talk say dis relationship go strong pass as e don ever be before," Trump talk.

Im promise say di US go dey support Tokyo well-well, as im tell Takaichi say dem go dey dia for "any question, any doubt, anything wey you want, any favour wey you need," as im describe di two countries as allies "wey dey di strongest level."

Trump also talk say Japan dey increase dia military capacity "very substantially," and Washington don receive "orders for plenty new military equipment."

Im talk say di trade between di two countries don reach historical level as dem dey prepare to sign new deal wey go dey "very fair."

"I go also like congratulate you as di first woman wey be prime minister. Na big deal be dat," Trump talk.

Takaichi talk say Tokyo "wan make di Japan-US alliance enter new golden age, where both Japan and di United States go dey strong and prosperous."

She talk say di two countries "don build di greatest alliance for di world, and together with you, Japan ready to contribute for peace and stability."

She still talk say she go dey use diplomacy "to protect Japan own national interest" and she ready to work with Washington to achieve dia "shared goal of free and open Indo-Pacific."