Israel don begin release Palestinian prisoners under ceasefire deal
Di buses wey carry di freed prisoners dey move go di occupied West Bank and Gaza, Prisoners' Media Office tok.
Relatives of Palestinian prisoners gather for di Nasser Hospital to welcome Palestinians who will be released as part of the ceasefire deal.
Israel don start to release Palestinian prisoners sake of di Gaza ceasefire agreement, na wetin di Prisoners’ Media Office tok.
Di office tok for Monday say buses wey dey carry di freed prisoners don comot from Ofer Prison, wey dey west of Ramallah, dey go Beitunia town for di occupied West Bank.
Buses wey dey carry di released prisoners from Negev Prison for southern Israel sef don dey go Gaza, di office still tok.
Di release happen after di Palestinian resistance group, Hamas, hand over 20 Israeli hostages under di first phase of di Gaza ceasefire agreement.
Dis na tori wey still dey develop.