Africa richest man dey plan to sell 10 percent of im oil refinery for Nigeria

Di Dangote refinery also announce plan to increase di oil wey dem dey refine to 1.4 million barrels per day, wey go pass di biggest refinery for di world.

Aliko Dangote bizness also include cement, flour and sugar.

Oga Aliko Dangote, we be di chairman for Dangote Group, don tok say im dey plan to sell 5 to 10 percent of di shares for im refinery for di Nigerian Stock Exchange by next year.

E tok dis one for one interview wey im do wit S&P Global.

Dangote explain say di move go be like wetin Dangote Cement and Dangote Sugar bin do before.

“We no wan hold pass 65 to 70 percent of di shares,” na wetin Dangote tok.

Im still add say di shares go enter market small small, based on how investors go show interest and how di market go dey strong.

Di industrialist still tok say im company dey reason partnership wit Middle East companies to expand di refinery and even build new refinery for China.

“Our business strategy go change. Now, instead of Dangote to hold everything 100 percent, we go dey get partners,” na wetin im tok.

Dangote still mention say Nigerian National Petroleum Company (NNPC) fit increase di shares wey dem get for di refinery after dem don reduce am to 7.2 percent, but na after di next phase of di refinery upgrade don complete.

“I wan show wetin di refinery fit do, then we go siddon discuss,” na wetin di chairman tok.

Di refinery don also announce plan to increase di oil wey dem dey refine to 1.4 million barrels per day, wey go pass di biggest refinery for di world wey dey Jamnagar, India, wey dey refine 1.36 million barrels per day.

“For July, Dangote bin tok say dem dey plan to expand di refinery from 650,000 barrels per day wey dem dey refine now to 700,000 barrels per day before di year go end,” na wetin S&P Global tok.

“For now, di goal na to reach 1.4 million barrels per day, but dem never give exact time wey dem go achieve am. Dis one go pass di biggest refinery for di world wey dey Jamnagar, India, wey dey refine 1.36 million barrels per day.”